Thursday, January 25, 2018

BBC NEWS PIDGIN Obasanjo dey too busy to know wetin dey happen...


Nigeria government say former president Olusegun Obasanjo dey too busy to notice di work wey di President Muhammadu Buhari government dey do. Minister of Information, Lai Mohammed, na im write di statement wey reply Obasanjo, after di former leader write 13 page letter to advice Buhari. Lai Mohammed thank Obasanjo say im take time to write di very long letter and say dem hope say im no carry bad-belle take write am. "On whether or not President Buhari suppose run for another term, na true say many Nigerians don dey call am to run again, while others no want am to return. "However, we believe say dis issue na distraction for di President dis kain time. Dis na because Mr. President dey spend every Read More

 Read Latest News Below
;

Obasanjo letter to Buhari: How Nigerians dey react.....

E don reach 24 hours since former Nigeria president, Chief Olusegun Obasanjo, use 13 page letter advice President Muhammadu Buhari make im no contest 2019 election.
Obasanjo talk for di letter say, Buhari no try at all for Nigerians, so make im go rest and leave 2019 for others.
Since then politicians and ordinary Nigerians don join mouth chook dia own on top dis tori.

Image copyright ALEXANDER JOE/AFP/GETTY
Image example No be today wey former Nigeria President Obasanjo don nack letter give leader dem
Di reason why dis letter dey important according Nnamdi Anekwe-Chivena, wey be national security expert and social media activist, na because whenever Obasanjo flash im red card give current president, whether na military or civilian, di person no go too last again.
Former presidents like Alhaji Shehu Shagari, Gen. Sani Abacha and even fresh one like Dr. Goodluck Jonathan don chop dis Obasanjo koboko and if dem fit talk now, dem go tell you say dem no enjoy am.Read More

No comments:

Post a Comment